Dat night I no drink, I no talk, I no sing, I just dey watch her, dey drink beer small small. But di one wey dey with her before Come talk say: “you dey waka go near door” Di man talk say: “you dey comot becos nothing dey here”. And di man, wey dey with her before Come dey harass me more and more, But I no mind am, I no mind am at all. When e reach di time when I wan go, She talk say: “you dey go? No go no go!” “You no go comot, no go no go, e dey early”. But di man, wey dey with her before Come start wahala. Im remember me, yes, im remember. One day me and my friend waka along street, You fit talk di person with plenty people we meet? You fit talk di person with plenty people we meet? Eight of dem. I no run, I comot knife. Una wey be born troway no fit kill me! Me and una go dig am! We go dig am well well. I no fit die for nothing. Na me first slap one person, Na me first stab one person. I no get choice than to do am! Dem come rush me, dem no wait. Fight come full ground, No way to stop am, no way to cool am. Somebody come rust me from back, I try hollam, I no see road, I try hollam, I no see road, But e don dey late. Police come as dey run And dem get hospital for inside prison. Di thing pay, di thing pay. Di doctor come tear me with two hand, Im talk say: “hold on, bro, if you go fit”, Im talk say: “hold on, bro, if you go fit”, I come dey endure. E don late well well when I comot for di hospital. She no come wait. But I forgive am, vex no dey my mind. I come comot her from my mind. Dat one wey dey before, Dat one wey dey before I go dey wait!        
© Chidi Anthony Opara. Translation, 2015